De'javu Lyrics
- Genre:Afrobeats
- Year of Release:2017
Lyrics
Eeee
Is right
This is not usually me o I don’t do this mehn
Me na street I no like stress fren
Nobody today is loving mehn
Ah
I dey form you dey form I dey talk you dey talk
I dey yarn you dey yarn I dey para you dey para
Who won soji who won bi say e own dorti
Coz you see me with that other girl
no mean say you go follow that other guy
You call am no bi say you start to dey vex
no even won know wetin dey happen sef
Always tell you the truth you dey put am for chest
if I tell you the truth u commot you go put am for where
Na me make the mistake I place you I place you for sky
Make only me fit dey reach you and together we fly
But now you dey fly too high
I peff still I know fit reach you
I dey hustle dey hustle die steady to give you things wey go make you smile
So tey my true true talk come dey be like lies for your eyes baby why
De’javu na so em be you keep saying you love me and me sef I love you
Benita don’t you cry wanna smile tonight down down
De’javu na so em be you keep saying you love me and me sef I love you
Benita don’t you cry wanna smile tonight down down
I know say I far I know say you far
I dey always dey try to ask you how far
Na music I dey na so lagos be
The truth be say e no go be as e be
Things wey you don do me too accepted you self beg me back
You sef know say you don do me too na you sef beg me back
E come be like say we no get front for body every saide wey we turn na back
This kin thing dey tire me baby e dey hot e dey fire me baby
Be like work e retire me baby nepa poll e dey fire me baby
I no talk say I perfect I won bury my adject
But you still hold that machete
Right in front of my heart I dey hustle dey
hustle to give you wat go make you smile
so tey my true true talk cum dey be like lies for your eyes baby why
De’javu na so em be you keep saying you love me and me sef I love you
Benita don’t you cry wanna smile tonight down down
De’javu na so em be you keep saying you love me and me sef I love you
Benita don’t you cry wanna smile tonight down