Major Freshout Pt.1 Lyrics
- Genre:Afrobeats
- Year of Release:2021
Lyrics
Major Freshout Pt.1 - Magnito
...
magnito wetin you dey do
na shoot I dey shoot
staff sergeant na crook I dey shoot
e be like music see na hook I dey cook
see as them dey laugh dey open thirty two
who you see
na 9ja comedians,all this skit makers
no big big comedians
I like basketmouth because he get correct yans
e dey carry people along the man e get correct plans
oya shoot buchi
no I no fit shoot am ,e get person wey I like wey seat down there with am
josh too funny
if I shoot bullet go hit am
kreb bello , I swear to God I fit beat am
bitter truth is that I don see one wey I no like
Acapella ,no
AY ,no
destalker ,no
bovi ,no
abeg no go shoot any of them wey I know
(gunshots)
chineke GOD who you shoot
na next week I go tell you who I shoot
magnito wetin you dey do
na shoot I dey shoot
staff sergeant na crook I dey shoot
e be like music see na hook I dey cook
see as them dey laugh dey open thirty two
ok make I ask ,did that him really him
what do you see from the back were your sitting
I hear (gboom)then I hear (giddim)
that giddim na that one be the Riddim
give me a name ,abeg who you shoot na
abi you miss ,dey tell me the truth na
kayi da hankali karke taka boot na
for kaduna na me and you them recruit na
ok make I give you low down on how the thing happen
comedy night ,shisha,and juice I carry apple
my girl get younger sister I carry her too
comedian wey get jokes and he act too
ushbebe na me he use dey crack that day
magnito sing if I get money because sapa dey
say the London wey he go na him osapa dey
magnito bone miami na him be takwab day
people begin dey laugh hmm
see niya melo ,person wey laugh me that day pass na kreb bello
UFC I'll punch him eyes like mac grego
my girl tap me and say na lets go
who you shoot ,person wey dey crack jokes
or who dey laugh
na next I go tell you when I baff
(spit vibes on the mix)