Wicked Man Lyrics
- Genre:Hip Hop & Rap
- Year of Release:2011
Lyrics
Wicked Man - Erigga
...
O no Na na na na na Oritse Femi oo Its ur Bwoi Erigga New Money Akpos, Omo I no like the Way u dey Behave U dey always dey do like say na U wicked pass for this Life abi? No worry, na God go judge u. He No know, Free Am
2 O Clock for night, I sit down my Doormot dey Bloaw/
With the hope say all the Pains go Cormot, as how/ I Just receive one mumu phone call/ My Paddy for Ekpoma, dem just use am count score/ Sabi Boy, No Be today dem don dey tam am/ I even hear say who Dog am na same person wey Bam am/ This Na Guy man wey don commit tire for Port/ Use Kala Face U, u no dey leave till fire Comot/ Number One Butcher, U no wan follow am Do/ Cos Korokoro omo boy go duck u for School/ Na so e name tey cast, even when e Kawa/
Enter B-Side, e fuck up no still Sour/
Na So e just Be, person wey be say dey follow u roll/ Na d same person wey go change am for u when its time to go/ Dem?? The Guy na Runs, omo boy no know/ Hook(Oritse Femi): Hey Mr Wicked Man/ turn around and see what happening Behind U/ U just dey take us for a Fool/ Bcos we dey use small mind dey serve U/ Hey Mr Wicked man/ Change Ur ways/ All this ur bad bad tin wey u dey do/ One day go be your judgement day/ One day, judgement day/ One day one day one day go be One day/ Mama go market, Pikin go school, Papa go work/ All this na make dem fit arrange wetin pikin go chop/ The Small Eba and Ice fish wey dem arrange give am/ Na wetin go dey her belle, till evening come meet am/ Her Uniform na Tear Tear, but Papa no care/ E own na to sit down with compound men dey drink beer/ Dey argue Politics, e so love Jona/ But after Subsidy knack am, na Once e bone am/ On this faithful Day, Mileh dey market dey sell/ Pileh need Bar Badly, so he go block her for there/ E no too tey, boys enter market throway for air/ Flying bullet knack mama and papa for there/ Pikin don reach house, no key to enter house/ Cos Pileh forget to drop key when e dey go out/ She don siddon her dooormot, day don dey Dark/ Repeat Hook Which Can life be this, wey one man go siddon/ On e own P, dey inflict pain on his fellow man/ Boko dey bomb for one side, that one no pain dem/ Na the small fuel wey I dey see put inside my ride/ People dey die for protest, government turn their Face/ People wey police kill, wetin con happen to d Case/ Get mind come TV, dey Apologize/ When who don die don die, what is wrong with this guys?/ Shey na Bad tin we do, to allow u rule us?/ Our own brother for government, see wetin u dey do us/ Same God wey carry Abacha and Ghadafi go/ Still dey, no be threat, na the Truth I just dey yarn u so/ Repeat Hook It is what it is mahn What goes around comes around mahn. Nothing Loss o Normal Level, u Understand