- Genre:Holiday
- Year of Release:2018
Lyrics
Hero - Tim Godfrey
...
wetin I for do who I for call ooo
if e no be you how I for run ooo
Baba oo,na you rescue meee
No money for pocket
No food to eat
My shoe na so so alignment
No house to sleep
You come rescue me
That's why you be my hero
Oh na only you be my hero
Na only you I go follow
Why you love me so
Even when I don loose hope
Everybody give me long rope
You come rescue me
That's why you be my hero oh
Na so dem dey call me mumu
Their mouth dey chop me like fufu
Dem yab, dem laugh me, reject me,eject me
Dem even say I no go school
Thank you Baba you no dey look face
Thank you Baba you no get two face
Na you rescue me
That's why you be my hero
I dey lonely, only me
You come love me
Come lift me
My spirit my soul take control
My heart and my love
My hero oh oh my hero
Na only you be my hero
Na only I go follow
When dem reject me,eject me
Dem wound me
Dem wan kpai me
Dem no know say na
Because of you I still dey oo
Na only you be my hero
Na only you I go follow