E GO BETTER Lyrics
- Genre:Others
- Year of Release:2024
Lyrics
E go better
E go better
I say
No be your fault o
E go better
E go better
For me and my brothers
E go better
E go better
If we make the right waka o
E go better
E go better
Yeah, yeah
One talk no gree make you talk another
That man just abandon him own niggaz
Leave them koro koro make them suffer
Carry the whole money run go pack am
Him own blood brother
Him arrest am
Community show but
Them no get money to bail am
So the judge no get choice but to jail am
Evil men begin cry
But e no solve am
Aliri jirim anya
Wenne forget am
I say make you comot hand
Juwa gwome aka
I no go gree
I no go gree
Omo, we go contest am
Biri kam biri
But them them no believe am
Make we arrange am
In order order
Na so we suppose put am
Hnmm
E go better
E go better
I say
No be your fault o
E go better
E go better
For me and my brothers
E go better
E go better
If we make the right waka o
E go better
E go better
I no just happy
How Hillary treat Gadafi
Do am like small pikin
Bury am without coffin
Scapegoat we like Cosby
Then blow us like Kobe
Man dey try gather
Them dey busy dey scatter
Omo
The wahala sef e reach Sahara
Everything jaga jaga
No leader
The last one him go slaughter
Him never come back
Ahh
Why e be like that
Me sef I no get somebody to ask
You dey look for work
But you no see am
Him pay him tax
But the light them no give am
So tay complete tithe
Na him pay am
But the heaven sef
Them still deny am
Him don try
Biko
Make you no laugh am
If him get leader
Somebody for don help am
This life
E get as e be
Brother
I say make you Leave am
No be your fault
Na so them plan am
President carry our money
Him go Eliza
Governor carry him own
Put for bunker
Them put am there
For their own safety
If you complain
Them go carry you go jury
Ahh
Him sef, him go shelf am
Somehow
Them go expect you to dey accept am
Omo
OYO
Na so e be
On your own
Asap, asap
We need to correct am
If you get strength
Now na the right time
For you to show am
E go better
E go better
I say
No be your fault o
E go better
E go better
For me and my brothers
E go better
E go better
If we make the right waka o
E go better
E go better
I say no be your fault o
No be my fault
Them never born me
When them kill Jesus Christ
Listen
Make una hear our cry
E go better
But na person
Wey we dey sick
No be real disease
Make una share the things
Wey we need to live
Ayhh
E go better
Because me and my brothers
Them look better
When them rock on their clothes
When they put on their shoe
I want make their wallet too
Make e full
E go better
If we do the right thing
We dey try our best
Make una try una own
Otherwise guys go rass
Guys dey rise
E go better
Na we go make am better
Because we dey rap better
Talk better
We dey marry better, born better
Why e be say the country no go better
E go better
The race go better
Africa sef
We go make am prosper
My niggaz hold your head higher
E don better already
Na just a matter of few time
E go better
E go better
I say
No be your fault o
E go better
E go better
For me and my brothers
E go better
E go better
If we make the right waka o
E go better