![Rising Sun](https://source.boomplaymusic.com/group10/M00/12/02/ec34efefff864fe291d985f0e400ffa1_464_464.jpg)
Rising Sun Lyrics
- Genre:Others
- Year of Release:2021
Lyrics
Oh na na na yeh
Oh yea yea
Hear my story
Charger charger yeh yeh
Why e be say all people wey dey around me dey cry oo
Why e be say people wey I love always dey frown oo
Why e be say promises I made I no fit do oh
E come be like say baba god sef no dey for me
Jah where you dey
Why e be say all my efforts no fit come through
Why e be say all me efforts no fit come through
I tell my mama I go make am proud
But right now now my mama don Kpai
I tell my Popsy I go see him through
But as you see me so I never do that
I tell my girlie oo I go buy Benz for you o
My girlie don wait she don dey lose weight
But I never disappoint you
Everybody don run
Cos I no fit bring chaw for the table
My guys don japa cos I no fit bring food
Wowo
Why e be say all my efforts no fit come through
Why e be say all my efforts no fit come through
I'm a superstar I know that right
Rising sun one day I go set
Do your own make I do my own
I believe in God Jah go come through
I no fit fail I don dey work hard
I no fit fail I don dey do grace
I no fit fail baba go come through for me ehe
Come through for me
I no fit fail baba go come through for me
One day one day monkey go go market e no go return
Say
One day na one day monkey go go market e never to return
Say say
I'm a superstar I'm a rising sun
I'm a superstar I'm a rising sun yeeeh
Sun when don rise that sun must set
One thing I know for sure one day I must set Oluwa ni
I'm a superstar I'm a rising sun
I'm a superstar I'm a rising sun
I'm a superstar I'm a rising sun
I'm the rising sun yeh
I'm a superstar I'm a rising sun
Iye iye iye iye
Sun when don rise that sun must set
One thing I know for sure one day I must set Oluwa ni
I'm a superstar I'm a rising sun
I'm a superstar I'm a rising sun