Medal Lyrics
- Genre:Hip Hop & Rap
- Year of Release:2022
Lyrics
Everyman get a time to shine, life na turn by turn
Make I for no envy my neighbor, I want my own
I've seen tables turn, I've watched bridges burn
Dem say life na school, everyday we live, we learn
See me now, like play like play I don reach 30
I hear say life na comedian but the shit is not funny
Na time and chance, who God choose, him dey show mercy
Indomie done quick, no mean say person wey cook beans lazy
God, wetin you fit do if wine can flow out of water
Give us bread, make we know say the problem na butter
I know we no dey try, I swear no reason the matter
Days are cold, lord your children now need showers of blessings
The circumstances got us living life with no choices
We're scared to speak up, everyday the youths are loosing voices
We're stock with our shells, we dey live like tortoise
We don't need to die young, we need second chances
Bless us with open doors, give us connect
Before the year go finish, we suppose don collect
Everywhere red, me sef, I don't need a prophet
To tell me say pocket e don tire for empty wallet
I know say no be you lord, na work of the devil
Because the plan you have for us is good, it's not of evil
Listen to us oh lord, hear the cries of your people
Lead us not into temptation, deliver us from all the evil
Them say I be king ogbeni I never see my throne
Make I for no envy my neighbor God I want my own
E be like play I don dey old, time sef don dey go
I hear say the patient dog e die, e no still chop the bone
How I wan take rule my world, like glo network slow
Even for street, transformer don dey first is blow
God abeg shine your light, for this side person battery low
The money problem be like MTN e dey everywhere you go
The life sef na war, everyday is different battles
Ndi Igbo si, obu onye ma mmadu na egbu mmadu
Every canoe has a paddle
Every mallam hold your kettle
Brother Dey your lane I dey my lane, shikina matter settle
The only thing we fear na see finish Baba God abeg
No be person fault na condition make crayfish bend
As much as we know the enemy, protect us from the friends
We dey smile with us na them go wan still kill us for the end
The struggle is real, see my love for gold has turned me a digger
I fear for myself, cz I can't tell if I'm a saint or sinner
Watching chances getting slimmer, while the dreams is getting bigger
Sometimes if I reason the life finish, e dey burst my liver
The life sef short like knicker
I hear say the truth is bitter
But las las like Hebrew women, safely we go deliver
Cz im still a believer, never giving up on my redeemer
If dulling is a sin God know say some of us we no be sinners
No one can stop me now
Cz I got my foot on the pedal
And I keep pressing down, while my eyes is on the medal, medal
And I'm reving it
Take control like I'm reffing it
Shit is precise and I'm definite
When they say they got my back I'm double checking it