11 59 Lyrics
- Genre:Hip Hop & Rap
- Year of Release:2022
Lyrics
Amam na chi'm nonso
Ebizina na chukwunonso ohh
Chukwunonso
Amara chukwunonso
God I thank you for life, thank you for fresh air
No be everybody wey start this journey we still dey here
Baba God, like this Ehen, year don dey end
Some of us we no see flour, make we no talk of bread
Phone dey ring, see am, na family dey call on me
I be like calculator, all of them dey count on me
I don dey hustle since January, I never pick
Even my dreams turn nightmare
How I wan take sleep?
Oh, God of 11:59,
The year don finish wetin we dey play na extra time
No forget say na by this time you path the Red Sea
When you said peace, even the wind stood still
What of for Canaan, dying minute water turn to wine
Omnipotent God, wetin concern you and time
No be 90years wey Sarah receive her miracle?
Na you deliver Shadrach, Meshach and Abednego
Always on time, you are never late
Na you be that same God, Baba you never change
When all hope was lost, Lazarus came forth
After all the suffer, I hear say Job still touch
God, we don hustle as our power reach, wetin remain na make we testify
We don gather bread, person don bring fish
Na you we dey wait make the thing for multiply
I'm just a few months the year don pass
Some of us no see mathset, talk more of compass
But deep down we dey trust with our whole heart
Na dying minute dem say answer sheet dey full pass
Woman wey dey find pikin, no dey wear pant sleep
Na man wey never see problem dey run dey hold him prick
We don cry, Baba God, answer us
Call our name, make we come forth like Lazarus…
Amam na chi'm nonso
Ebizina na chukwunonso ohh
Chukwunonso
Amara chukwunonso