
Endtime girlz Lyrics
- Genre:Hip Hop & Rap
- Year of Release:2021
Lyrics
Chei e Eh
Tjz Empire baby
Wah wah
It's Erico again oh
Listen eh
If my Girl nor fit wait till the day I make am
Then she's free to leave cos me I nor fit fake am
To impress another person GF wen nor send me
Like say if I go astray she go fit amend me
Cos nowadays girls nor be like the ancient
They all about the money dem nor like to patient
Like old time girls Dem ready to wait
Cos dem know say you go make am one day is never too late
See, Forget the school when you go forget your grade
If you nor get money my brother I swear that love go fade
Cos nowadays girls Dem like already made
So that when dem get issues someone go come for their aid
With alot on your head alot on your mind
Nowadays girls go make you feel like say you nor dey grind
My brother if dem do you nor go too dey reason
Cos everybody for this life get e time and season
Nowadays girls wey you call your treasure
When you nor get money I say na you dem go pressure
For their satisfaction and their own pleasure
They say dem love you but dem go still dey pressure
The Girl I been dey date always asking for money
She say long as we dey date she nor go need her family
So all her problems and bills she put it all upon me
But if I nor get the money I look for am like Johnny
I frustrate till the extent ask my guy banayo
I kon dey plan to do ritual but I nor be kanayo
But later me I plaster you know as e dey go
Even tho say I dey suffer I nor dey let am show
My girl say she nor go show me real love until I blow
Because say music na my work but I nor get job
But me I nor dey bother Sha cos I nor be God
Na God when give me talent know when HE go blow my job
So my prayer everyday I know it's not in vain
Na only time e go take one day dem go hear my name
I go be the superstar when me I dey proclaim
And my X which was my girl na my picture she go frame
Cos nowadays Girls too dey crucify
No matter wetin you give them dem nor dey satisfy
Dem too dey horrify dem too dey terrify
Dem nor dey reason your profile before dem justify
If you nor get money all this girls are occupy
To toast dem be like audition you nor go qualify
Dem nor dey dignify but they're always specify
You wen dey listen to me you suppose don testify
Nowadays Girls love you when you dey progress
But when you going down same girls go give you stress
Small boy like me when dey try to live my life
Because of Girl boy nearly kill me live my life
Chei
Heh
It's Erico again oh
Yeh yeh
Tjz Empire baby
All I did for you is nothing
All I did for you is nothing ing ing
You're wicked
You're wicked