
My Country Lyrics
- Genre:Hip Hop & Rap
- Year of Release:2024
Lyrics
High
High
It's erico again oh
Eh
Now listen
Say
I want to talk about my country insecurities
And talk about the hardship and police brutalities
Talk about the Government and less immunities
Cos of bad environment in rich and poor communities
Road traveling isn't safe fear of kidnappers
We nor know who be who cos there are so many kidnappers
Person nor fit control girl from kogi to abuja
If nor be flight cos he dey fear make dem nor go kidnap her
The thing dey pain me e do me like say make i cry
Na only God know the amout of people when don die
Due to the hardship and inability to feed
The government doesn't care cos of their passion for greed
Rate dey high everyday we nor know wetin to fall am
E Go affect you if you're not making money in dollar
Both who nor go sch and those when be scholar
Some of dem na mechanic while some of dem na baller
Those people when talk say this government go favour me
Where all of una cos this government nor dey favour me
Hope una dey enjoy or una still dey suffer
You collect bribe for this administration still dey suffer
To even travel self commot for this country
I nor go lie you brother is very very costly
To even go UK you need to hold like 20 mill
Not to talk of canada you need like 40 mill
Other country when they borrow from After dem chest am
When the money reach my country Dem go sitdown press am
Sit down office morning till night say dem dey write budget
Dem go still split am among themselves take collect gadgets
Collect different houses acquire many assets
Carry different fine girls when be say their ass set
Nor be say dem dey last dem dey quick dey release
But the country funds dem nor dey quick dey release
Now some pipo believe in juju some believe in God
Some believe in handwork while some believe in fraud
But I don't really care what anyone believe in
All I have to say is when dollar rate exchange go fall
I wonder why jesus nor die for sins and billz
Or die for billz and then he leave the sins
But he died for sins and only left the bills
Now some of us have to sin to pay the bills
Young boys when dey sch some like finish school
Cos even their state governor nor even finish school
Now i understand why ritualist na ritualist
Nor too close to dem make dem nor add you join their ritual list
Wetin frustrate me go hustle legally
Fit frustrate another person hustle illegally
Commot hand for good then shook hand for evil
Cos even nowadays even servant nor dey civil
Mini wage 30k bag of rice 80k
I believe you know why some pipo are really not ok
Even garri self when be say na local made
Don still add money too I feel like I'm betrayed
Gas is on the increase fuel price stil dey high
To even high don high omor indomie na die
Five note ten note fifty note useless
We use more money than before we normally use less
What about the police they are steady on harassment
You talk back at them cos you know your right na embarrassment
Later dem go tell us say police is your friend
I only wonder if police brutality will end
I even pity dem sometimes the young and the old
Especially those corofo ones when dey stand for road
Their salary nor even reach to buy dem bag of rice
So I'm not surprised that some police aren't nice
As everywhere no soft and everywhere no good
Na why my friend when be ulcer patient don stop to select food
The level when the country dey na only God go save us
Cos this country economy don really enslave us
But no matter how I complain reach who dey on seat
Go still rule over me till 4 or 8 years complete
Except say e go heaven then he tenor end
Then we pray say the next person when go rule go make amend
Now some pipo believe in juju some believe in God
Some believe in handwork while some believe in fraud
But I don't really care what anyone believe in
All i have to say is when dollar rate exchange go fall
I wonder why jesus nor die for sins and billz
Or die for billz and then he leave the sins
But he died for sins and only left the bills
Now some of us have to sin to pay the bills