Same Story ft. Ayomide Lyrics
- Genre:Pop
- Year of Release:2020
Lyrics
Them say we get good roads but na up wey them dey pass
When mosquito bite, them say na jand e good pass
When we be the vote you say na you wey good pass
Say brother bone gist owey
Omo since them born me
Same story wey I done dey hear since
Oh oh oh oh oh
Story I done dey hear since
Oh ohhh
Same story I done dey hear since
Our politicians sabi preach wetin them no dey practice
To even keep to their word na mathematics
Ahhh, I done tire for their lapses
Our land is green but our leaders them dey clear the grasses
This song is for Nigeria, this song is for the masses
I'm voicing for the poor, the low level classes
Ahh, shey una done tire for their tactics
It is time to take a stand, open your eyes, remove your glasses
Election is here again now they need your vote
So they pretend to be a sheep but inside life Hausa goat
Promises upon promises but nothing dey sup
Wetin dey sup (same story wey I done dey hear since)
You live or you die, nobody cares
I call myself lucky when I see some of my peers
On a daily basis na my people them dey tears
Na because say work no dey, that's why steady boys dey press
Na them go jons you owey
Na them go toast you owey
But this I'm sure yea yea
Omo since them born me, same story wey I done dey hear since
Oh oh oh oh oh
Story I done dey hear since
Oh ohhh
Same story I done dey hear since
I pledge to Nigeria my country with all my heart
I love my country and I hope that nothing tear us apart
But politicians them dey carry everybody future put for mouth
And when we talk them go say shut up, what are you talking about
Arrest you till you tire, use your life do round about
Enough is enough, see naija people make we fall out
We done tire for their format
When we talk them go use combat
Them dey treat us like we no be human being, we no important
It is right about the time for y'all to think about our feelings
Your dealings, the killings, not chicks wey wear bikinis
Giant of Africa, no light kakaraka
All these things no dey touch una? Una heart kakaraka
If e better for my people, ajibole no go dey
SARS for no kill junior cos yahoo yahoo no go dey
Baba God na where you dey?
Tell me why you dey delay
Ayomide
Sing the chorus, I leave this talk for another day
Omo since them born me, same story wey I done dey hear since
Oh oh oh oh oh
Story I done dey hear since
Oh ohhh
Same story I done dey hear since