EndSarz ft. Corizo & Dee Will Lyrics
- Genre:Hip Hop & Rap
- Year of Release:2020
Lyrics
Listen
Yesterday i call my paddy flourish
To follow me go see promoter cus the padi kpokish
Normally flourish na my padi when sabi package
So me and am together promoters go call me savage
I nur go lie somebody say we dress like armed robbers
But reason am na promoter we wan go see we nur fit gam normal
So i dey on fakebkinks flourish dress like who dey receive 30mill
Our face dey shine like we just finish eating party meal
We reach but stop then I tell flourish make we comedown
He say brother make I use this chance see momsi brother
For front na there yawa for gas
Instead to come down for bus stop now we go come down for sars
Well no shaking I'm not a criminal dem nur fit hold me
By the way most of the people for this area know me
As artiste I Dey clean I fit nur Dey holy
But I nur know say flourish my padi Dey with kpoli
Damn those two for back come down we want to see you
Just jejely waka come nobody's gonna kill you
They search me see 4 condoms in an empty wallet
Oga these ones na yahoo boys dem when never collect
Flourish smile you know that feeling say them nur fit search you
If I slap you for that smile we go still search you
Na there flourish pick race sars say dem nur fit chase
If you run faster than my leg my bullet go still catch you
Yei oga please this my guy is just an only child
If you kill am now e mama nur go only cry
She fit comit suicide and comit double homicide
And what will be my cus the woman know say e Dey my side
I ran there like one of Fredrick muller dog
Saw my paddy flourish lying lifeless in a pool of blood
This things happens everyday I nur just sit down Dey guess bars
All I'm saying is make we put head together end sars
End sars, end sars this men they kill our best stars
Just because from early age dem don begin Dey get cars
Bentleys and guest house, hotels and extras
And then on the other hand nur get money to rent house
But what's our business shey na dem waist their major time
Why E be like say young boy success come be like major crime
These things happen everyday I nur just sit down Dey guess bars
All I'm saying is make we put head together end sars, end sars! Chei
I've been fighting for survival
But everytime I hit the road the men on black they all be judging me wrong
I've been fighting for survival
But everytime I hit the road the men on black they all be judging me wrong
Iye eh iye eh
Baba o
Iye eh iye eh
Baba o
Iye eh iye eh
Baba o
Iye eh iye eh
Baba o
Stop there where you Dey come from
You be yahoo boy
Ah my face officer why you Dey slap me
I go shoot you now
El Corizo
Give me your phone I say make you give me your phone
I'm I'm coming from class sir
Listen
I'm a artiste
The way this country be now e be like backwardness na out portion
Make dem share country 50 50 give me my portion
If this country good na pride see I for Dey brag put
Even for the football aspect na we Dey carry last put
Now finish school download vpn you start to hustle
Sars go still they burst boys like say dem be burble
Dem say dem wan fight corruption I laugh, na prank
With connection study agriculture you fit still work for bank
Recession Recession Recession lord nur be my portion
Steady facilities for the country which one Dey function
Oh lord have mercy on politicians they don't know what they doing
All these stealings all these killings lord I know it's their doings
Oh lord have mercy still on the harizonal diet
The boy's still young lord I don't want to die yet
I wan ibile everything like a reminisce
Make money by any means, in the presence of my enemies
Iye eh
End sars
Iye eh
End sars
Baba oh
Iye eh
End sars
Iye eh
End sars
Baba oh
Iye eh
End sars
Iye eh
End sars
Baba oh
Mona end sars na
Nur worry wo coordinate ourselves
End sars