![My Pikin](https://source.boomplaymusic.com/group1/M01/2D/C4/rBEezlwPsNCAT3N7AAChRhAdIvs683.jpg)
My Pikin Lyrics
- Genre:Afropop
- Year of Release:2018
Lyrics
My Pikin - Prinx Emmanuel
...
Introduction...
Mama tell me say pikin
make you come here
I get so many things
we you suppose to come hear
I tell her say I dey come
I dey iron trouser
she say make you stop that
come here find chair
make you sit down
she say make you hold your ear
I hold my ear
I come dey fear
na so I ask am Mama wetin dey sup
My pikin, my pikin
as you carry your bag they go school
make you no go there go fall my hand
my pikin my pikin
as you carry your bag dey go university
make you no go there go fall my hand
she say make you no forget
na only you were I get ooh
na you go carry me comot for ghetto
oya go the school and make me proud
ehh---ehhe--ehh---ehh
uhh--uh---uhh--
pa--ra--ra--ra...
I don reach school every thing nice
e no tey I don forget wetin mama talk
I don draw tattoo
they don call me baddest
my name na the king of the planet
I don dey follow the men wey know the way,we they run big racket
na so we they drink anything that is drinkable
smoke anything that is smokeable
fuck anything that is fuckable
ehh anything that is ehh
They say our next movement
na to go carry senator from airport
I tell them say I no fit do that on
na high tension oo
they say make I go,say I be fear fear
say I no reach man I just get bear bear
no forget to
na only you wey i get oo
na you go carry me comot for ghetto
so one night I enter house
they just bring light,I on TV
na network news
I see my friends for headline
yawa don gas oo,yawa don gas oo mogbe
na for Kiri Kiri..na for Kiri kiri
my pikin my pikin
as you carry your bag dey go school
make you no go there go fall my hand
my pikin my pikin oo
as you carry your bag dey go university
make you no go there go fall my hand
she say make you no forget oo
na only you I get oo
na you go carry me comot from ghetto
oya go the school and make me proud
' outro'