Trouble Dey Sleep ft. Konga Lyrics
- Genre:Afrobeats
- Year of Release:2017
Lyrics
Corruption - Eedris Abdulkareem
...
fellow Nigerians
na your boy Eedris Abdulkareem
listen carefully
I bumped into Alhaji Atiku Abubakar for Dubai
we talk say we need to restructure Nigeria
and when I met major Almustafar at Nnamdi Azikwe Airport
he said Eedris, how old is corruption
(how old is corruption)
na who be corruption age mate
na who born corruption, sebi Na bad leaders
Senegalese Jollof Rice, Senegalese Jollof rice
dem say Senegalese Jollof Rice is sweeter than Nigerian rice ooo
trouble dey sleep, Yanga go wake am o
musicians dey sleep, politicians wake dem o
trouble dey sleeep shakara go wake am o
Nigerians dey sleep, our mumu Don too much
say make I no go Yankee, and Nigeria dirty
area boys plenty, say if I want to shoot my videos say make I shoot am for naija
any Politician way dey seek for medical attention, make e seek am for Naija
say no to children of politician wey dey go America
time to school for Naija
Na everyday we agalaga up nepa
if you sha dey make my people dey happy
dey pupa
even when we sing music, dem go pirate am
area boys go hala para hala for their paper
even when you??? o, even kidnapping sef don kolo
politicians Don steal our money????
eleda masun, chi
trouble dey sleep, Yanga go wake am o
musicians dey sleep, politicians wake dem o
trouble dey sleeep shakara go wake am o
Nigerians dey sleep, our mumu Don too much
Naija how old is corruption, Na who born corruption, na who be corruption age mate, no be our leaders?
Mr minister don't teach me nonsense, make you think about how you go solve Nigeria problem,
okay Biafra, Niger Delta still are dictating
Bokoharam, Badoo how is level of kidnapping
we no fit shoot videos because of insecurity
bad road, bad infrastructure in my country
Nigeria get belle since 1960
na him make p square dey give you awada kerikeri
no light, we don by fuel, buy gas tire, we don create employment for federal government
Music Industry is not regulated
like the banking and the telecommunication industry
Nigeria dirty, Na hin make we dey go America go shoot our music videos
oga sir
(how old is corruption)
na who be corruption age mate
na who born corruption, sebi Na bad leaders
Senegalese Jollof Rice, Senegalese Jollof rice
dem say Senegalese Jollof Rice is sweeter than Nigerian rice ooo
ajekun iya leje, ajekun Iya leje, ajekun iya leje,
if Nigerians don't revolution
trouble dey sleep, Yanga go wake am o
musicians dey sleep, politicians wake dem o
I believe in nigerian Jollof Rice, no be Senegalese rice
honorable minister we appreciate your effort
but I want to tell you something
we don't need a divide of Nigerian musicians
I believe in King Sunny Ade
I believe in Oyenka Iweanu
I believe in O Suliki
I believe in Eedris Abdulkareem
I believe in Daddy Showki
I believe in Dada Awosiba
I believe in Chris Okotie
I believe in Olisa Adebuwa
I believe in K K K Ogungbe
I believe in Femi Kuti
I believe in Paul Play Dairo
I believe in Sound Sultan
rugeddy baba
Ali baba to n pami lerin
I believe in Indo mix pelu Akin Alabi
I believe in Pasuma wonder
sir Shina Peters
lakowe street awon animasaun kwame
I believe in Anthony general Abubakar Demaliami
konga soso on d beat da