God Abeg Lyrics
- Genre:Others
- Year of Release:2022
Lyrics
Oh Lord o see your boy don come o
Oh Lord o the matter don cast o
Where the money dey o o
Where the raba dey e yah
I dey here dey waiti oo
Make you no delay
Remember me father e God abeg
Wire my aza eh God abeg
Make sapa no killi person
Elele elele elele God abeg
Remember me today God abeg
E don tey wey I dey pray God abeg
Abegi no delay e eh eh God abeg
For this life I no fit kill myself
Give me Hennessy make I rest
Cool my stress
Before the pressure go tear my shirt
Serious matter
No body want to dey suffer
I dey hustle for Abuja
I still go find my way to Atlanta
Eh eh para dey para dey
If no be money no dey call me
Yawa dey yawa dey
Folake don dey vex o
Remember me father e God abeg
Wire my aza eh God abeg
Make sapa no killi person
Elele elele elele God abeg
Remember me today God abeg
E don tey wey I dey pray God abeg
Abegi no delay e eh eh God abeg
I dey wait for my turn o
I no want make the que con dey long o
Mama say make i wait for my turn o
I dey wait o
Mo ma wait o
I want to cruise in my yacht o
I want to eat nkwobi and salad o
Make the fuel no finish for my light o
Remember me father e God abeg
Wire my aza eh God abeg
Make sapa no killi person
Elele elele elele God abeg
Remember me today God abeg
E don tey wey I dey pray God abeg
Abegi no delay e eh eh God abeg