![Put Me On](https://source.boomplaymusic.com/group10/M00/03/24/09e86c121fb647f78ad7534f0cc1a3ce_464_464.jpg)
Put Me On Lyrics
- Genre:Afrobeat
- Year of Release:2021
Lyrics
Put Me On - Gilly Craine
...
Chairman with the benzo
Chairman wey dey sort for the ghetto
Abeg show me the way I dey vex o
Because so many years I dey hustle
Eh, no money I dey get o
I no wan live a life with regret o
Abeg chairman show me the way
On the run wey I no fit delay eh eh
Man I dey on the streets like commando
Wey all the boys dey come and go
My prayer be say me I wan to blow
Pull up the range and make we roll
In a convoy way, charley time no dey
We no come to play.. man we no come to play
Plenty money for body, change the story for mommy
I hope you see what I dey see, hunger no fit follow me, no fit swallow me so I say
(Put me on Id.me
Put me on Edd
Put me on, I wan get money
Put me on, paste me link o) 2x
Where you dey make you bring me job
No delay charley I never chop
I say poverty just dey blow my jaw
When the money come we go buy champagne and pop
Yes I’m a hustler, wey I dey move with a formula
You for know say I no be your regular. Very soon with my tesla
The big ways I dey follow
When I pose me I no dey borrow
This life I dey live am solo
I been driving away that sorrow
The big ways I dey follow
When I pose me I no dey borrow
This life I dey live am solo
I been driving away that sorrow
Chairman eh
(Put me on Id.me
Put me on Edd
Put me on, I wan get money
Put me on, paste me link o) 2x
You for know say I speed up o, I dey strap up o
Never go mess up o, I dey grind up o
What be the move I dey want update
What we go do I dey want upgrade
What be the plan o, what be the plan o
Monday to Sunday my guy I dey ball up o
Where money dey I go dey there so
Everything I dey want o
Money go come i go sort out o
Shouts my gees on the street
Mandem we never dey sellout o
Paying my dues everywhere I dey
Plenty money for body, change the story for mommy
I hope you see what I dey see, hunger no fit follow me, no fit swallow so I say
Put me on Id.me
Put me on Edd
Put me on, I wan get money
Put me on, paste me link o