![Ena Sarz](https://source.boomplaymusic.com/group10/M00/06/02/2160835f4b4f4658b8e293e1abb87f9b.jpg)
Ena Sarz Lyrics
- Genre:Hip Hop & Rap
- Year of Release:2021
Lyrics
Ena Sarz - Corizo
...
I been fighting for survival
But every time I hit the road
The men on black they all be judging me wrong
.........
can’t even think straight tho, but its like
.........
I been fighting for survival (but what am I gonna say)
But every time I hit the road
The men on black they all be judging
......
Listen
Yesterday I call my paddy florish
To follow me go see promoter cos he paddy pockish
Normally flourish na my paddy wey sabi package
So me and am together promoter go call me savage
I no go lie somebody say we dress like armed robber
But reason am na promoter we wan go see we no fit calm normal
So I dey on fake blinks
Florish dress like who dey receive 30 mill
Our face dey shine like we just finish eating party meal
We reach bus stop then i tell florish make we come down
Say, brother makeo use this chance see momsi brother for front
Na there yawa for gas
Instead to come down for bus stop now we go come down for SARS
Well no shaking
Am not a criminal them no fit hold me
By the way most of the people for this area know me
As artist I dey clean
I fit no dey holy
But I no know say florish my paddy dey with kpoli
........Damn......
Those two for back come down we want to see you
Just jejeli waka come nobody’s gonna kill you
They search me see four condoms in an empty wallet
.......hiss.....
Oga this ones na yahoo boys them wey never collect
Florish smile
You that feeling say them no fit catch me
If I slap you for that smile
We go still search you
Na there florish pick race
SARS say them no fit chase
If you run faster than my leg
My bullet go still catch you
....Yeeh
Oga police this my guy is just an only child
If you kill am now /olorun/ he mama no go only cry
She fit comit suicide and comit about homocide
And what will be my fate cos the woman know say he dey my side
——gunshot——
I ran there like one Fredrick muller dog
Saw my paddy florish lying lifeless in a pool of blood
This things happens everyday
I no just sit down dey get bars
All am saying is make we put head together end SARS
End SARS End SARS
This men they kill our best stars
Just because from early age they don begin they get cars Bentleys and guesthouse hotels and extras
And them on the other hand no get money to rent house
But what’s our business
Shay na them waste their major ime
Why e be like say young boys obsesse con be like major crime
This things happens everyday
I no just sit down dey get bars
So all am saying is make we out hands together end SARS
I been fighting for survival
But every time I hit the road
The men on black they all be judging me wrong
I been fighting for survival
But every time I hit the road
The men on black they all be judging me wrong
/////Chorus//////
The way this country be
E be like say backwardness na our potion
Make they share the country 50/50
Give me my potion
If this country win my pride
Shay I for they brag put
Even for the football aspect
Na we dey last put
Now finish school download vpn you start to hustle
SARS go still dey burst boys like say them be bubbles
Them say they wan fight corruption
I laugh na prank
With connection study agriculture
You fit still work for bank
Recession recession recession
Oh lord no be my potion
Quality facilities for the country
Which one dey function
Oh lord have mercy on politicians
They don’t know what dey are doing
All the stealings all the killings
Lord I know it’s there doings
Oh lord have mercy
Still on the Arizona diet
They bounce through young
Lord I don’t want to die yet
I wan ???? everything
Like a reminise
Make money by any means
In the presence of my enemies
End SARS
End SARS
End SARS
End SARS
End SARS
End SARS
May una end SARS na
End SARS
No worry we go coordinate ourselves
End SARSI been fighting for survival

They search m