SeniorMadMan Lyrics
- Genre:Alternative
- Year of Release:2021
Lyrics
Dem been dey give me problem
But my God pass dia problem
Dem been no want dey send me
But where I come from
Nobody send anybody
Make you dey for your government
For every corner where you dey
Men dey govern dem
I be King for my area
Na who first craze
Na him be senior mad man
Na who first craze
Na him be senior mad man
Dem no dey
Put phone for back pocket
Go ATM
You go hear word
Men go run you street
Your eye oh
You go see blood
Dem no dey tell blind man
Say rain dey
Fall for outside
I say na wahala
For the place wey
Dem come from
And if you no sabi
Do this one
Omo na long talk
I say I neva
Neva
Neva
Neva
Neva
Neva
Neva
Neva
Neva
See another type
Oh no no
Eh yeah
I say na problem
For the place wey I come from
Zanga the place I come from
Ghetto boy
Get over
Get it on
She neva get
Anoda kind of love
From this
From this street
Konji
Pon this beat
Na condition
Make cray fish bend
And Better soup
Na money kill am
If life show you pepper
Shey You go use am do
Pepper soup
No food for lazy man
No be for who
Get restaurant
If trust dey this life
Water for no dey cook fish
Dem been dey give me
Dem been dey give me problem
But my God pass dia problem
Dem been no want dey send me
But where I come from
Nobody send anybody
Make you dey for your government
For every corner where you dey
Men dey govern dem
I be King for my area
Na who first craze
Na him be senior mad man
Na who first craze
Na him be senior mad man
Na who first craze
Na him be senior mad man
I tell them say
Pikin wey dey find party rice
No suppose fear dance
I get am before
Oga that one no be property
When big men dey dance
You sef shake body
You sef