TED TALK Lyrics
- Genre:Others
- Year of Release:2024
Lyrics
It's Flowtain baby o
Baby baby baby o
Because I dey sing love songs they forget say I be street
Thank God for internet many boys don benefit
Na only when I receive alert wey me I dey shine teeth
Money give me confidence I no proud at all
Life dey very serious if you like you dull
I dey avoid the wahala wey go stress my brain
Cause peace of mind no be wetin dem dey sell for mall
Them no dey do BDSM with koboko
Every spirit of overdo I rebuke o
You never taste canadian you wan dey sniff coco
Did you come to see me or you came for polo?
People can be very very funny you know
No be by sweet voice who go blow go blow
Naso e just be who no go no know
You no go fit to see me finish like UGO.C.UGO
I'm working I'm working I'm working
Later when I make am they will tell you that I'm lucky
Very soft boy more actions less talking
If I toast you, you no gree you collect blocking
For all the fake friends na God go help us
As we step out jah protect us
My own guy insult me for anonymous
After all na disciple betray Jesus
I no shock at all
Clap for others till e reach your turn
Listen to me whenever I talk my son
Sometimes you fight, sometimes you run
Na oversabi dey make person turn victim chai
Do you want to be like him? Chai
Life is not the way you think
I no go fit talk everything I see
Omo shout out to the n*** wey dey for me
Shout out to mumsy she no dey play with me
Shout out to my pops he dey pray for me
And to all the pretty ladies wey dey stick with me
Flowtain baby o baby o
Shout to n*** I dey drive them crazy o
Living real life non stop we are blazing o
Omo everybody tell me say I am amazing o
And I'm chilling right now recording in the studio, sorry in my home
I'm living life I'm happy
Hope your happy?
Enjoy the EP!
And I'm chilling right now recording in the studio, sorry in my home
I'm living life I'm happy
Hope your happy?
Enjoy the EP!
Flowz