Eulogy Lyrics
- Genre:Others
- Year of Release:2024
Lyrics
They tell me say you no dey house again
Say you don go another journey
I no fit to believe my eyes again
So I dey write the Eulogy
When I go fit to see your face oo brother
I wan craze as everybody dey talk the matter
I come dey look for your trace oo brother
I no fit forget you oo
I been dey like seventeen
You and me dey for SS3
We get freedom
We no dey look anybody wey follow me
Friday nights na kolorbi
We dey finish our money
You, me and Taaba kommot prep
Fly outside go chop Indomie
So accept this eulogy
As you leave it dey bother me
I dey write this eulogy
As you leave it dey bother me
I no fit to accept
I know say if you know sef you go vex
Come dey wonder who go be next
But only Oluwa knows the best
It don teyy wey I hear from you
But you know I'm always there for you
Saturdays and the holidays
We dey always stake our bet
I dey like nineteen
Me and you dey University
We dey the same room
We no dey go church so we avoid the security
Friday nights na jolly
Me, you, Kuti and Ngugi
I dey write the melodies
But my heart is stuck on these memories
So accept this eulogy
As you leave it dey bother me
I dey write this eulogy
As you leave it dey bother me