
19 something something Lyrics
- Genre:Others
- Year of Release:2024
Lyrics
Alarm no reach your side?
I go wear am 500, if I wear am 500...
Oboi I no dey laugh o
Actionn!!
Na since 19 something something
Na him we dey fight
The same people wey tell us say
Make we stand for our right
Dem push us go left, go right
But still we dey smile
Now everybody don know say their talk na lie
I say nobody know o (nobody know)
Wetin dey happen? say nobody know
I say nobody know o (nobody know)
How e take happen? say nobody know
Now you want make I show love
Make nobody telli me one love
You see the way things dey go rough
The masses dey complain e too tough
If no be popo, na the sojos
But everybody know who dey do most
If you dey leave house you gaz still know say
No guarantee say you go reach home safe
Ah ye o
Ah mogbe o
The average man dey see gbege o
Oni kilode ah mokun o
How I wan take feed my kele?
I say nobody know o (nobody know)
Wetin dey happen? say nobody know
I say nobody know o (nobody know)
How e take happen? say nobody know
I say we do not want no crisis
why try to punish us for your sins?
The people dey beg
Dey waka with leg
Hunger hold poor man pikin for neck
We just dey look and our eye dey red
Wetin man fit do to chaw daily bread
Ah ye o
Ah mogbe o
The average man dey see gbege o
Oni kilode ah mokun o
How I wan take feed my kele?
Actionn!
Na since 19 something something
Na him we dey fight
The same people wey tell us say
Make we stand for our right
Dem push us go left, go right
But still we dey smile
Now everybody don know say their talk na lie
Their talk na lie
Their talk na lie
Their talk na lie
Know say their talk na lie