Better Days Lyrics
- Genre:Others
- Year of Release:2024
Lyrics
Cheers to you my guy
One day them go say we do juju, walahi
Na who dey for me today, go chop with me troway.
Better days must surely come
E no easy, so many people wan use me
Oga leave me! paddi mi, Wo!
Double your hustle F all the bitches, fashy snitches, ore mi
Who no know go talk say E don blow, see I don show
Anything you do go work oh, Amen!
Frenemies kole work oh, Amen!
Para for the baggar wey no work, Amen!
Thank God for the money wey we touch, Amen!
Happy day, eh! Holiday, eh!
Money dey, eh! Party dey, eh!
Make we dey jolly dey go, (jolly)
Steady on a daily till the money don show
So, cheers to you my guy
One day them go say we do juju, walahi
Na who dey for me today, go chop with me troway.
Better days must surely come
When you make am them go love you
Without money them go hate you
My brother, oya hustle, make you double your hustle
Anything wey you do make you involve God
Anything wey you do make you involve God
Shey, shey you wanna make am you go dey
Amorawa t'abarirawa
Sha'anu fun mi t'abarirawa
Aje o
Amorawa t'abarirawa
Sha'anu fun mi t'abarirawa
Cheers to you my guy
One day them go say we do juju, walahi
Na who dey for me today, go chop with me troway.
Better days must surely come
So, cheers to you my guy
One day them go say we do juju, walahi
Na who dey for me today, go chop with me troway.
Better days must surely come
(Omo I no go lie you eh! I no go lie you
Me I don tire like this eh, I don tire
How many years e go take, how many years e go take to run this thing before funds go drop
How we go take to hustle?
I don hustle pass all those ballers, all those people wey be say dey ball, I don hustle pass them
On top of everything you know, family go still come dey bill me on top
Which kind life be this?)