![Domestic Violence](https://source.boomplaymusic.com/group10/M00/02/09/8c587e0546294cc288620c13b30c1b01_464_464.jpg)
Domestic Violence Lyrics
- Genre:Others
- Year of Release:2024
Lyrics
Yes yes, this song goes to all of una wey de beat woman, de beat una wives, stop am…
I sabi this girl for school
Back then she was very cool
Now her boyfriend just de beat am
She no know why e de beat am
Popo no believe her case
Koko don finish her face
Suffer don finish her face
He don forget when he chase
Baby I love u too much
If we marry, I beat you too much
No be wetin him been tell am o
Na good boy vibe him been de sell am o
Now she don enter 1 chance
She don de go meet lawyer fast
He de beg for one more chance
Omoge come make we dance, jare
If you de beat woman stop am
If you de beat woman stop am
We no de beat woman here o
We no de beat woman here o
If you be real man jaiye
If you be real man jaiye
If you be real man jaiye
Girls them de follow us jaiye
If you be real man jaiye
If you be real man jaiye
If you be real man jaiye
Girls them de follow us jaiye
He don de cheat on him wife
He don de beat on him wife
Which kind yeye man I marry
Of all the men na-him I carry
She come de gist all her friends
Them don de give her ideas
Them say let's go for a girl's trip
Na there u go meet your best preek
Husband de cheat with him side chick
He no know say him be side preek
Which kind wahala be this
I say, which kind wahala be this eh
Thank God say the girl na good girl
She no de do that kind thing
He go still come house de beat am
She no de do that kind thing, jare
If you de beat woman stop am
If you de beat woman stop am
We no de beat woman here o
We no de beat woman here o
If you be real man jaiye
If you be real man jaiye
If you be real man jaiye
Girls them de follow us jaiye
If you be real man jaiye
If you be real man jaiye
If you be real man jaiye
Girls them de follow us jaiye