4PM In Ekosodin ft. Kay-Z Lyrics
- Genre:Hip Hop & Rap
- Year of Release:2018
Lyrics
4PM In Ekosodin ft. Kay-Z - Pompay
...
You wan be high class come uniben make you try pass,
Everyday na night class sleep go where you eyeglass,
Even with your effort your g.p still dey for 3rd class,
Lecturers no wan hear they cut your g.p with cutlass,na so e dey be for our school you know,
Shout out to all my lecturers and double shout out to students,
Salute to all the teachers wey teach me not to be prudent,
Forget say i be fresher yesterday i don graduate at last,
Shout out to all the lecturers wey fail me even when i pass,
Shout out to h.o.d and to dean and to v.c,
We clap for all for all the mises room we no see,
Shout out to all the student politicians and to sug
Shout out to all the people wey campaign because of SUV,
To all the porters when the beans no don una dey seize hot plate,
They never gimme space,where the list,where person wan stay,
To all the students wey dey for one bunk where five people squat,
And all the students wey dey borrow spoons and even borrow pot,
Shout out to all my room mates wey cook beans wey no dey call me,
Shout out to all my hall 4 or hall 3 boys wey no dey dull me,
To all the students wey dey for night class the ones wey go dey sleep,
And all the students wey no let you jack the ones wey go dey preach,
Shout to all my goons wey dey for school people wey no dey shame,
All of una wey fresh like kayz the levels don dey change,
As we all na student we dey pass cos we dey jack,we see failure we the pass,later disgrace we no dey carry last
Where dem dey x2
Where my people,where my goons where them dey x3
Shey you remember when we enter school with that 100 level face,na so so file we dey carry up and down like lawyer's we get case,
Forming frosh for ekosodin cos they never give us hostel space,but when that clearance beat you u go resemble who chop craze, wait,
Shout out to all my male friends even the ones wey dey break dance,
Shout to all my hall 2,shop 2 girls una too make sense,
Shout out to all my fake friends wey dey gadge up with room mate shirt,
Shout out to my freshers wey dey look for hall 4,law,basement,that is where we all started from with that fresher face we still dey form and that time i think say night class na where lecturers still dey come,
Nothing man no do just to hustle for that B.S.C we no dey joke with attendance especially when its GST,
Shout out to all my fellowship brethren them wey dey claim holy,
Shout out to all my guys wey uniben help wey suppose dey poly
Shout out to all my gbroke boys wey dey stairs dey take gbori,
Shout out to all egbons wey dey run things for ekosodin,
You see hostel life dey very rugged,if you wan baff you go need to look for bucket,
For night class people dey use all the socket if you lose guard dey go put your phone for pocket.