Wetin De Sup? Lyrics
- Genre:Others
- Year of Release:2023
Lyrics
Wetin de sup?
Everything be getting tough
Something is wrong
Why the country don de rough?
Them de lie to us
Public funds no be your own
Why you go de chop am without conscience
We are sixty three
Why we no get light two four seven
Refinery no de work
Graduate no go see work
Where all the money them de borrow de go
New tenure, new borrow without plan to pay
Wetin de sup?
Everything be getting tough
Something is wrong
Why the country don de rough?
Them de lie to us
Public funds no be your own
Why you go de chop am without conscience
As I step out I see my brother
Wey de hustle for daily bread
Eye don red, filled with tears
Wetin sup oh my bro ?
See as country e don de hard
School fees cost, my child de house
I no even see food chow
Fuel don cost and I no see light
As I enter the market everything cost
Wetin I go go tell my boy
See as headache don full head
Only God fit save me now
Ahbi dem dem don us juju
Why we de do like Mumu
Why we de do like we no de see am
Ahbi we just de blinded by religion, tribalism
Nepotism de chop us go
Wetin de sup?
Everything be getting tough
Something is wrong
Why the country don de rough?
Them de lie to us
Public funds no be your own
Why you go de chop am without conscience