Wetin I do Lyrics
- Genre:Gospel
- Year of Release:2023
Lyrics
(Talk)
Hey! The thing wey you do for me e plenty e dey yanfu yanfu. I no say I no qualify oooo but you save my soul Baba you too much. Hahahaha.....
Baba God I thank you oooo
For wetin you do for me
I know say I no qualify oooo
To be your own pikin
But you send your son Jesus Christ from obodo heaven oooo
He come die for my sake To save me from hellfire
I promise to love you oooo
To serve you everyday
To tell the story of your love
As long as I dey alive
I go dey sing you my songs oooo to glorify your name
Until the end my Papa
I meet you for paradise.
Call : Wetin I do wey you love me so oooo
Resp : Baba oooo
Call: I know say I be nobody but you love me
Resp: Baba oooo
Call: You take me from the miry clay
Resp : Baba oooo
Call : So tey you come make
me somebody
Resp : Baba oooo.
Na wetin I go give you oooo
To say thank you Papa
I no get money,
I no get eluplane oooo
I no get motor oooo
You no need any of dem
You own heaven and the earth
You are the all sufficient God
Baba God na my praise you want and na im I carry come
Receive dem from my hands oooo It's from the bottom of my heart
Nobody dey do the things wey you dey do
All the glory belong to you
Na im make I dey hail you Baba God.
Odogwu! Odogwu! Odogwu!
Call: Wetin I do oooo
Resp : Baba oooo
Call: Wey you love me so
Resp : Baba oooo
Call : I no qualify oooo
Resp : Baba oooo
Call : Still you love me oooo
Resp : Baba oooo.
Eeeeh eeeeh ooooooh
My Popsi oooo
Resp: Baba oooo
Call : My defender
Resp : Baba oooo
Call: In times of need
Resp : Baba oooo
Call : You no dey fail me at all oooo
Resp : Baba oooo
Call: You no dey use me play
Resp : Baba oooo
Call : You carry my matter for head
Resp : Baba oooo
Call : I am the apple of your eye oooo
Resp : Baba oooo
Call : Nobody be like you
Resp : Baba oooo
Call : You no dey change at all oooo
Resp : Baba oooo
Call : You dey fight all my battles
Resp : Baba oooo
Call : Na so you dey give me Victory
Resp : Baba oooo
Call : King of Kings, Lord of lords, the mighty man of war
Resp : Baba oooo
Hahahaha.