![Everything Go Dey Okay](https://source.boomplaymusic.com/group10/M00/05/21/4a58b0ba0e154bbda5741c36bf6552f5_464_464.jpg)
Everything Go Dey Okay Lyrics
- Genre:Soul
- Year of Release:2023
Lyrics
Oh oh
Oh
Oh oh oh
If you get money make you flenjor
But no use am spoil another man own oh
If Oluwa bless you make you enjoy oh oh oh
But make you no look down on another man oh
See this life wey we dey no be play
Some people dey hustle some people dey pray
Make Jah blessings dey come their way
I know say one day everything go dey okay
Mr officer dem say you be my friend
But no use your power oppress me abeg oh
Shey your work na to serve and to protect
No be to dey mud innocent people abeg oh
See this life wey we dey no be play
The matter don tey omo no be today
Make una try to dey feel una victims pain
I hope say one day everything go dey okay
Mr President na you be the Oga
Na anything wey you talk be the thing dem go do
Shey you like as your people dey suffer
Common food to chop don turn to WAEC o
See this place wey we get na we own
Shebi dem talk say there's no place like home
Shey na till all man Ja go obodo oyibo
Make we reason am o e no make sense abeg o
I know say one day everything go dey okay
Everything go dey okay
I know say one day everything go dey okay
Everything go dey okay