
Am Jeje Lyrics
- Genre:Afrobeat
- Year of Release:2022
This song is not currently available in your region.
Lyrics
Am Jeje - Gman Kajad
...
AM JEJE
...Oh yeah, Zimbocrix...
....It's your boy Gman Kajad...you know how do?
Na the way we dey go o, na the way we dey go o, na the way we dey go o, e dey tire me every day,
I don't know wetin dey happen oo, when the poor man dey suffer, na so the rich man dey jolly, for they spending our money,
One day e go better ah, we need to put our hands together, show ourselves love, no man go carry bad belle, we go day pop champagne,
Let the leaders give everybody money make we jolly, by this time next year, everybody gonna dey happy,
If you feel me leave trouble follow me, make we jolly, tell me what gain you gain from the troubles you cause,
Want to know o, wont to know, want to know o what you gain, you causing yourself also pain, much pain, most pain,
If you follow me happy o, in this great Naija, lemme hear you say...
Naija na we own o, make we handle am jeje, Nigeria na we country o, make we handle am jeje, We no need fighting again o, make we settle am jeje,
We no need corruption again, make we handle am jeje,
We no need killing again oo, we no need shooting again o.
Nigeria people uu, (people uu),
Nigeria people uu (people uu)
Are we going insane or wetin dey happen here? We go see truth finish ley, chai, close mouth,
Let the sufferer suffer suffer, na so we go go go go, be like America one day?
We no know wetin we want oo, na him dey make our people suffer,
We never see anything na truth if we no take our injection, precaution, this is our nation, Nigeria!
Naija na we own o, make we handle am jeje, Nigeria na we country o, make we handle am jeje, We no need fighting again o, make we settle am jeje,
We no need corruption again, make we handle am jeje,
We no need killing again oo, we no need shooting again o,
Make we handle am jeje.
Things go better someday in Nigeria, where we dey go to, me I no know, abi na front abi na back o, make we show love to ourself o,
Abeg o forget tribalism, and love other ethnicity, embrace our nationality and shun all kind of iniquity,
Make we make we jangolover, be like brother and sisters, for inside we Nigeria,
Mama/papa them are do jogodo, Ibo, Hausa, Yoruba bring ololo,
Begin begin dey shake your body, dey chop your money, dey touch your body, yowaaa! yowaaa!
Naija na we own o, make we handle am jeje, Nigeria na we country o, make we handle am jeje, We no need fighting again o, make we settle am jeje,
We no need corruption again, make we handle am jeje,
We no need killing again oo, we no need shooting again o.
Nigeria people uu, (people uu),
Nigeria people uu (people uu)
Are we going insane or wetin dey happen here? We go see truth finish ley, chai, close mouth,
Let the sufferer suffer suffer, na so we go go go go, be like America one day?
We no know wetin we want oo, na him dey make our people suffer,
We never see anything na truth if we no take our injection, precaution, this is our nation, Nigeria!
You and I o, You and I o...
We no need any other person....
We go make it better...
You and I o we go make things alright.