![Nobody](https://source.boomplaymusic.com/group10/M00/02/06/34adee8b53d64a7aa508ea53d54ccc05H1500W1500_464_464.jpg)
Nobody Lyrics
- Genre:Afrobeat
- Year of Release:2022
Lyrics
Nobody - Southern Eddy
...
Nobody send Nobody care Oh
if you want the pay then you go work Oh
Cause this life you dey na on your own Oh
Everybody get him own matter Oh
Nobody send e your father Oh
make you just dey grind for the cash out Oh
You no get the funds na your kwanta Oh
You no get the work then you go starve Oh
Nobody wan know your story
Nobody wan give you glory
Nobody wan know your state
them just wan see you fail
Nobody wan know your matter
Nobody wan know your father
Nobody wan hear your banger
them just wan see you fail
On God Oh
As you dey you dey do your thing no dulling Oh
No time Oh
If you no make am na you sabi Oh
Nobody wan know your story
Nobody wan know your face
Nobody wan know your problem
Or how to solve your case
Nobody wan know your balance
Nobody wan check and balance
Nobody wan know your name
Or yawa wey you dey
My God Oh
I dey pray for pays and blessings oh
for this life oh oh
if you no make am na you sabi oh
So my brother as you dey grind oh
Make you just use your 99 oh
cause them just want dey criticize oh
But no go let them determine oh
As Oluwa dey for your back oh
Make you just focus on your grind oh
Cause hardworking get em reward oh
Everybody just want see the results oh
On God Oh
As you dey you dey do your thing no dulling oh
No time Oh
If you no make am na you sabi oh
As I dey grind no body cares
They hear my sound dem criticize
Shadykelv na the number one
For the count down baby
But I still dey work hard baby
Anytime they hear my sound
Dem dey dance to the beat
Oya rewind
I don dey cash out baby
My guy don pay me baby