MUSA Lyrics
- Genre:World Music/Folklore
- Year of Release:2021
Lyrics
Ahh
Uh yeah
Eji eji let's go
Nothing Musa no dey see for gate oh
Nothing Musa no dey see for gate oh
Shey you feel the gbedu
Listen to the things wey Musa dey view
Charcoal pot sit down dey yab kettle
You know how e be between me and you
No money my broda man you be jew
Nobody go waste their time to help you
Na inside life I talk no be book
So you know say wetin I dey talk na true because
Nothing Musa no dey see
Nothing, nothing, nothing
Nothing Musa no dey see
Nothing Musa no dey see
Nothing, nothing, nothing
Nothing Musa no dey see
No go talk say you hear am from my mouth
As I dey see am I dey yarn
All the things wey me people talk about
And the things wey dem bad people dey plan
Eh eh eh
East to West and North to South
Musa see things wey heavy for mouth
Go ask the mad man for roundabout
Him go tell you say walai
Nothing wey Musa no go see for gate
Nothing wey Musa no go see for gate oh
Nothing wey Musa no go see for gate
Nothing wey Musa no go see for gate oh
E dey see cold, e dey see hot
E dey see tall, e dey see short
E dey see many things many things
From the genesis oh
Musa dey see fat, e dey see slim
Nothing Musa e never see
E dey see many things many things
From the genesis oh
See I get many things for me to talk about
But me I no fit shout oh
Me I no fit hala
I just wan smoke my loud
And party all day like it's gon' be my last
I want to flex my mama
I want to talk my mind
So reason with me when I tell you say
Nothing Musa no dey see
Nothing, nothing, nothing
Nothing Musa no dey see
Nothing Musa no dey see
Nothing, nothing, nothing
Nothing Musa no dey see
No go talk say you hear am from my mouth
As I dey see am I dey yarn
All the things wey me people talk about
And the things wey dem bad people dey plan
Eh eh eh
East to West and North to South
Musa see things wey heavy for mouth
Go ask the mad man for roundabout
Him go tell you say walai
Nothing wey Musa no go see for gate
Nothing wey Musa no go see for gate oh
East to West and North to South
Musa see things wey heavy for mouth
I no come to play
So make you reason me when I tell you say
I get many things to talk about
Everybody wanna sing
But nobody wanna talk their mind
All the things wey we see for ground
No be today wey e start
No be today wey the country bad
No love for we father land
Everywhere I go hypocrites wan bring me down
But I go shine like a young sunflower
I be black man power eh eh
Nothing wey Musa no dey see
Nothing wey Musa no dey see
Nothing nothing
Nothing nothing
Nothing nothing