![Area (Acoustic)](https://source.boomplaymusic.com/group2/M00/04/7E/rBEeM1f8T8iAT2d8AACxQahzzlY482.jpg)
Area (Acoustic) Lyrics
- Genre:Afrobeats
- Year of Release:2006
Lyrics
[ti:soundsultan- Area(Acoustic)]
Oh oh
Ye ye ye
Ajo o dabile ee
No matter where u go make u try come back area o
Area o
Na naija aa ah aa
Ti ode ba ti le pada wale o
Wale o oo uh o
How i wish say
I fit reach you anywhere you dey e
You dey eee
Far away ee e
That one no say make you dey bone area o
Motherland e oo na your area
Chinedu somebody borrow u ego
Make u take carry go chicago
Remember nnamdi sell him car
So you go go america
All these people wey been de raise you
Sill dey stay for face me I face you
You promise say you no go fashi them
Every other month you go de tachi them
Hillary wey you been promise to marry
Still de wait o' boy she don tarry
When she go see you na inside ovation
You marry oyinbo from another nation
Use mago mago get dough
Now your oyinbo wife don know
Next thing you know she don go report you
Wetin you know them don deport you
How i wish say
I fit reach you anywhere you dey e
You dey eee
Far away ee e
That one no say make you dey bone area o
Motherland e oo na your area
Ajo o dabile ee
No matter where u go make u try come back area o
Area o
Na naija aa ah aa
Ti ode ba ti le pada wale o
Wale o oo uh o
You been say na 1 year
E come turn to 2 years
E don go for seven years
But you de serve eleven years
Even when your papa die
Plus the tears your mama cry
Bayo for chicago
Them dey miss u for okoko o
Biodun for canada
Your mama still de wonder
Igba wo lo tơ ma pada o
Remember for naija you get iyawo
Ko da bi ile
Ko da bi ile
Ko da bi ile e
Ko da bi ile
Ko da bi ile e
Ko da bi ile e
Ajo o ma da bi ile e
How i wish say
I fit reach you anywhere you dey e
You dey eee
Far away ee e
That one no say make you dey bone area o
Motherland e oo na your area
You say you go call e o
Every body wait tire for your call
Ote o why you go like so o
From germany to carry coco enter yankee
But then coco burst for your belle
Rest in peace e o
Fly away I come wonder if one day you fit to come e o
Your papa land I understand say you de so far away
Long long way from home
Long long way from home
You’ve gone a long long way from home
A long long way from your papa land
Ajo o dabile ee
No matter where u go make u try come back area o
Area o
Na naija aa ah aa
Ti ode ba ti le pada wale o
Wale o oo uh o
Sound sultan
Na naija we dey wene
All brothers in the west
All my brothers in the east
North south
Now we doing it
All this people wey dey rule us
Make una try make naija sweet
So that people go won dey come back home
Respect kennies music