![Chop I Chop ft. Tony Tetuila](https://source.boomplaymusic.com/group2/M00/04/D0/rBEeM1f8oiiAVDcxAACsqPWyMu4512.jpg)
Chop I Chop ft. Tony Tetuila Lyrics
- Genre:Afropop
- Year of Release:2005
Lyrics
Adex how far now
How you dey
Wetin you dey chop na
Leave wetin I dey chop alone
Dey enjoyment there
Wetin give me chop na abeg
Ya ya ya na
Give am now
See im mouth
I no give am
Wetin you dey chop
Everything for head
Chop and die
Ori I ma jen ya ada nikan gbe ile o
Eda mi ma jen ya ada nikan gbe ile o
Ori I ma jen ya ada nikan gbe ile o
Eda mi ma jen ya ada nikan gbe ile o
Ada nikan je
Ada nikan mu
Ada nikan gbe inu palour bi eranko
Ori I ma jen ya ada nikan gbe ile o
Pave way
Push it out
Ajo je
Ajo je
Ajo je lo laye
Chop make I chop o
No one knows tomorrow
E fit be your turn o
And e fit be mine
Oh oh oh oh
Ajo je
Ajo je
Ajo je lo laye
Chop make I chop o
No one knows tomorrow
E fit be your turn o
And e fit be mine
Oh oh oh oh
My people abeg o
Listen to my story
Na about three friend
Wey no get money
Naso them dey live life
Wey dey very funny
The kind of job they never
Tried before
From kaya to shoe maker
Driver to messenger
Go slow hawker
They even try
To do all ***
Baba alaye which level na
Find something for your boys
Find boys something o
Baba ya eran fun awon boys o
As them dey do kaya
Dey go for one day
Them help one man
Carry load along the way
Naso dem miss the man
Wey give them load to carry
Naso them carry load
Go where dem dey stay
One of them come say
Make dem check wetin dey
To their surprise wetin dem see
Na plenty money
Dem dey very happy
Dey come dey jubilate
Ajo je
Ajo je
Ajo je lo laye
Chop make I chop o
No one knows tomorrow
E fit be your turn o
And e fit be mine
Oh oh oh oh
Ajo je
Ajo je
Ajo je lo laye
Chop make I chop o
No one knows tomorrow
E fit be your turn o
And e fit be mine
Oh oh oh oh
My story
The story
Story never end o
They come talk sey
Before den wetin make dem chop o
Thereafter
Later
Dem go know whats up
How to share the money
No need for them to worry
Dem talk sey
Make one of them go buy food come
As he dey go
Devil come enter him mind o
And e go good if this money
Be mine alone
Naso him buy poison
Put for the food o
The other two wey dey for house
Sef dey plan
Sey the one wey go buy food come
Make dem kill am
So that the money go be
For just two of them
As he bring food o
Dme no waste time
Dem just kill am
Dem no know sey their death
They wait for them
Naso dem sit down
Dem come start to lem
As dem chop the food
Naso dem payi
Na who come get the money
Somebody tell me
Ajo je
Ajo je
Ajo je lo laye
Chop make I chop o
No one knows tomorrow
E fit be your turn o
And e fit be mine
Oh oh oh oh
If I buy buredi
Ajo je
If I buy biscuit
Ajo je
If I get fine girl
Ajo je
Ajo wetin
I go censor your face
With slap now
Gone are the days we need to tell her
I think is time we first off ra
This na the problem of nigeria
Wey dey make me and you dey halla
Na plenty resources
God take bless us
Most oga dem
Chop am leave us
God punish those wey dey chop your own
Plus my own
Put their own
And other thing wey dey this country
Most of the rich men
Too dey selfish
If you sef be that kind person
Chop alone
You go die alone
This nigeria for don better
If una chop remain for others
This na why we dey tell you today sey
Chop I chop
Na im be the best thing
Chop alone
Die alone
Chop alone
Die alone
Die alone
Chop alone
Chop alone
Die alone
Chop alone
Die alone
Chop alone
Die alone
Oh oh oh oh
Ajo je
Ajo je
Ajo je lo laye
Chop make I chop o
No one knows tomorrow
E fit be your turn o
And e fit be mine
Oh oh oh oh
Ajo je
Ajo je
Ajo je lo laye
Chop make I chop o
No one knows tomorrow
E fit be your turn o
And e fit be mine
Oh oh oh oh
Ajo je
Ajo je
Ajo je lo laye
Chop make I chop o
No one knows tomorrow
E fit be your turn o
And e fit be mine
Oh oh oh oh
Ajo je
Ajo je
Ajo je lo laye
Chop make I chop o
No one knows tomorrow
E fit be your turn o
And e fit be mine
Oh oh oh oh