![Lord When ft. Hype MC](https://source.boomplaymusic.com/group10/M00/02/03/96005e2a6d36422dae275668ffee2085H3000W3000_464_464.jpg)
Lord When ft. Hype MC Lyrics
- Genre:Others
- Year of Release:2025
Lyrics
Lord when ooh
Star doc
Last night for twitter
something been dey trend
How e started and how it's going on at the moment
Baba God you no Dey sleep
You suppose see comments
You suppose see my own too when I ask you say Lord when
I don try Baba God
I chatter bus from Abuja enter port Harcourt
I follow fine girl from 'Ola enter UNIPORT
Aluu boys nearly break my head like say na kolanut
For DM i Dey slide like say I be defender
All year round January to December
I keep it real no lies I no be pretender
My slip still cut and the game no enter
I don chop breakfast hot plate of food
You know that kind mama nkechi rice And stew
I love babe die I nearly go draw tatoo
Lord when lord when you go send me my boo
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
I don try
I don cry
I don fast oh
I don pray pray pray
Lord when oh
Me I don Dey taya
eh eh
Papa God abeg when you dey plan hear us
Person wey get Prado, still dey find Hilux
If we dey sick now na you fit heal us
Even Obyna Daddy Muna dey here dey feel us
Chei
No be say we dey question you
But why people wey you create no dey fear you
Sodom & Gomorrah go dey look us
Dem suppose dey vex when them see us
Person wey im roof dey leak no supoose dey answer Rufus
My Punchlines fit make devil shout Jesus
Na our leaders we dey kill us
Like a bad network those men no send us
Now to eat three times na big plus
Every small thing this men go wan cheat us
Star Doc abeg e no dey vex you
E dey vex me die oh abeg thank you
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
I don try
I don cry
I don fast oh
I don pray pray pray
Lord when oh
Me I don Dey taya
eh eh
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
Lord when oh
I don try
I don cry
I don fast oh
I don pray pray pray
Lord when oh
Me I don Dey taya
eh eh