![Mathematics](https://source.boomplaymusic.com/group2/M00/00/1D/rBEeM1fu-leARekHAABBOwyTp0o292.jpg)
Mathematics Lyrics
- Genre:Afrobeats
- Year of Release:2009
Lyrics
Mathematics - Sound Sultan
...
INTRO
All stand
Greet (Good morning sir)
Good morning, you're welcome to Jagbajantis High School
My name is Sound Sultan, your new Mathematics teacher
By the way, do you understand pidgin English? (Yes sir)
Ok, na weytin we go use henceforth
Ok, carry your paper
Carry your paper
People of this world dem plenty (S'etigbo)
Sins of this people many, so many (S'etigbo)
Many times plenty, multiply am (Multiply am)
Many times plenty, multiply am (Multiply am)
Multiply am, the answer you get na weytin dey make poor man dey cry
The answer you get na weytin dey make rich man dey mess and leaders dey bad
The answer you get na weytin dey make young boys & girls join bad gang
Answer you get na weytin dey make innocent man rot inside the jail (Kere eh, kere eh)
And dem no gree to grant am bail (Kere eh, kere eh)
Ooo, Everybody oya o join jagbajantis
To solve mathematics (wey dey dabaru our continent so ooo)
Oyinbo say, na BODMAS we go use dey solve mathematics
So follow Jagbajantis (Oya carry biro)
B for Brotherhood (Love your neighbour as yourself, o tan o)
O for Objectivity (Be objective **)
D for Democracy, democracy (No matter how bad it is, e beta military)
M for Modification (Of our behaviour, let's turn to the Saviour)
A Accountability (If you been dey chop money, abegi take am easy)
S for Solidarity (United: we stand; divided: omase o)
We enter new millennium (S'etigbo)
We just like 120 million, won po gan (S'etigbo)
World population na 6 billion (6 billion)
Divide that one by 120 million, all together oya (All together)
The answer you get na weytin dey make people dey ja, comot for Naija
The answer you get na weytin dey make people must travel, by hook by crook
Answer na weytin dey make people dey sleep for embassy for visa
Answer you get na weytin dey make people dey sell dia property for ticket (Kere eh, kere eh)
But dem travel sibesibe (Kere eh, kere eh)
Ooo eh, Everybody oya o join jagbajantis
To solve mathematics (wey dey dabaru our continent so ooo)
Oyinbo say, na BODMAS we go use dey solve mathematics
So follow Jagbajantis (Oya carry biro)
B for Brotherhood (Love your neighbour as yourself, o tan o)
O for Objectivity (Be objective **)
D for Democracy, democracy (No matter how bad it is, e beta military)
M for Modification (Of our behaviour, let's turn to the Saviour)
A Accountability (If you been dey chop money, abegi take am easy)
S for Solidarity (United: we stand; divided: omase o)
You go stay AJ city (S'etigbo)
He lives in VG City (S'etigbo)
Paiko level for AJ city (AJ city)
Rich man corner be VG City (VG city)
Try add AJ &VG city altogether, oya (Altogether)
The answer you get na weytin dey make rich man oppress, and then suppress
The answer you get na weytin dey make poor man dey press, contain aggress
The answer you get na weytin dey make poor man dey try to
The answer you get na weytin dey make poor man pikin dey try to prove what they mean (Kere eh, kere eh)
Dem go dey ** (Kere eh, kere eh)
Ooo eh, Everybody oya o join jagbajantis
To solve mathematics (wey dey dabaru our continent so ooo)
Oyinbo say, na BODMAS we go use dey solve mathematics
So follow Jagbajantis (Oya carry biro)
Thanks for your contribution, now anymore question? (No sir)