E Dey Pain Me ft. Mallam Spicey Lyrics
- Genre:Afrobeats
- Year of Release:2005
Lyrics
Intro
E dey pain me o as I see the way my brother
Just dey hustle everyday no gain
E dey pain me o when we try to hustle and the
Christian o dey tell me trust and obey
E dey pain me pain me pain me pain me pain me
Pain me wey le e dey pain me pain me pain me
Pain me pain me wele
Tell me who be the sheep who be the goat
Wetin we chop wey dey hook us for throat
See dem looting for looting we throat know
Sey an some children wey their mama care
About how could dey deceive you everyday
Land for your office and your salary no dey
You go dey light your day nobody man go tell
You which way but I dey wonder sey when e go
Better when we go live like sons and daughters
When we go know sey tribe e no matter when
Will the situation of the poor people change for life
I tire what we need is the peace and unity brotherly
Love equal right in the society so why offer dem
Brutality to take away my sanity e
E dey pain me o as I see the way my brother
Just dey hustle everyday no gain
E dey pain me o when we try to hustle and the
Christian o dey tell me trust and obey
E dey pain me pain me pain me pain me pain me
Pain me wey le e dey pain me pain me pain me
Pain me pain me wele
We suffer too much I no go lie na truth I
Dey tell you walahi talahi every ghetto
Man dey try to get abilai because from
Small dem don dey cry dey cruise dey sell
Igbo for street when police come everybody
Go dismiss ghetto man dey find am hard
To see food chop that’s why most of dem
Dey do mumu job situation for my country
Get critical lack of medicine dey kill people
For we hospital cos the government no get
Time for us at all that’s why our economic
System dey fall ye ghetto man dey manage
Our country papa na bondage well this na
Mallam spicey rock steady blackface come on
We come live together come fit light up the place
To eat don hard for we gat my posing
Family for ritual our road don turn panti
Dem turn we girls to prostitute and boys
The loot job this kind of life is funny how
Man go ey live when he no get money this
Kind of life don dey run my tommy tell me
Olorun oba jowo show me the way the way
To break the chains off off the life wey we dey
E dey pain o
E dey pain me o as I see the way my brother
Just dey hustle everyday no gain
E dey pain me o when we try to hustle and the
Christian o dey tell me trust and obey
E dey pain me pain me pain me pain me pain me
Pain me wey le e dey pain me pain me pain me
Pain me pain me wele
If you say come dem go go if you say toady
Dem go say na tomorrow dem give you pain
And sorrow instead of we to spend na for we
To dey borrow dem carry our dogo put some
For swiss and some for tokyo abeg o e no gel o
Cos very soon the well go dry o people go shout o
Say egbami o and na the poor people go dey feel
The pain o wetin be the gain o if no pain o
But we dey suffer and we still no fit say no
E dey pain me o as I see the way my brother
Just dey hustle everyday no gain
E dey pain me o when we try to hustle and the
Christian o dey tell me trust and obey
E dey pain me pain me pain me pain me pain me
Pain me wey le e dey pain me pain me pain me
Pain me pain me wele
Ye man is to trust and obey abi no mind dem
En dem say make we just dey obey ye man
But right now is time for we to stand for what
We believe in alright ye who go raise in justice
For us provide amenities for the people dem
You know if everybody has a good mind let
Live as one ****time to arise it time to arise
Tribunal *** mallam spicey rock steady ***
Blackface see pain me pain me pain me pain me