Ogbeson Lyrics
- Genre:Others
- Year of Release:2023
Lyrics
Back then for Benghazi
When I dey for ogbeson
When I paro junction to junction
My people them know whats up
And I be like four
When my papa dey play me
Different cds
I be like four
When I start to dey
Listen to bob marley
My mama say make I gbelo gbelo
Make I no look uche face
Say life na turn by turn
Make I waka jeje
My mama say make I gbelo gbelo
Make I no look uche face
Say life na turn by turn
Make I waka oh
I be that small boy
Wey don turn to big boy oh
I be that small boy
Wey don turn to big boy oh
Can't lie to you
Most of my mandem
From way back
They been know my story
They been pray for my glory
But we dey act different movie oh
Mama mary pikin
The boy wey dey hawk dried fish
Lil man was always happy
To dance like daddy showkey
Then osakpolor
Tell me say make I vibe
For him studio
Some dey conner dey thief
Some dey conner dey fly
Different colour
The ones wey believe me
Na the same people
Wey no make me give up
The ones wey believe me
Na the same people wey no make I
My mama say make I gbelo gbelo
Make I no look uche face
Say life na turn by turn
Make I waka jeje
My mama say make I gbelo gbelo
Make I no look uche face
Say life na turn by turn
Make I waka oh
I be that small boy
Wey don turn to big boy oh
I be that small boy
Wey don turn to big boy oh
I be that small boy eh
Wey don turn to big man